OneJoblessBoy

The boy next door

Spiritual Connotation

Obinna don dey broke forever. He doesn’t even know how to spell wealth.
However, my guy JohnThomas dey in good health, always paying attention.
The usual tension for im boxers be like tension wey dey for pension queue.
Obinna get small confidence sha but whenever he walks up to a lady he likes,
the girl dey get even more confidence to snob am.
Now Obinna crush don open everything, set everything for front.
Obinna don kickstart im engine, the humpty dumpty ride don resume.
Obinna dey poke like pokemon, im dey pack like Pacman.
My guy don wake up to realize say na just dream but he stays excited.
Im waka go see Pastor about am and man of God don declare say the dream get spiritual connotation.
Obi dey burst laugh but Pastor no understand why.
You see this spiritual connotation? Obinna want more of am.
His dreams made impossible become impossible.

Ramota dey sell sausage for traffic but hunger hold am for neck like bow-tie.
She no dey go school and the aunty wey she dey stay with no cool at all.
Sometimes she dey starve but if she doesn’t play the fool, she will get thrown out.
Ramota aunty children dey baff for jacuzzi, dem dey sleep for luxurious bed.
Ramota dey sleep for kitchen store after she don clean the whole house.
Now, waiter stand for her front with big menu.
Ramota don maker her order.
As she dey chop, she dey order take away.
She wakes up with toothpick in her mouth, but it was all a dream.
She waka go see Pastor about am and man of God don declare say the dream get spiritual connotations.
Ramota dey burst laugh but Pastor no understand why.
You see this spiritual connotation? Ramota want more of am.
Her dreams made impossible become impossible.

Your opinion matters, please leave a comment